CHINYERE DEY WORK FOR BANK AS CLEANER,DEY TRAIN
HERSELF GO SCHOOL,SHE DEY STUDY BUSINESS
ADMINISTARTION FOR UNIVERSITY...AS SHE DEY
WORK,SHE MEET ETIM WEY BE STAFF OF DI BANK WEY
SHE DEY WORK FOR..ETIM DON REALLY ADMIRE
AM,DECIDE TO GET CLOSE TO AM..AS DEM START
RELATIONSHIP,ETIM CON TAKE OVER DI PAYMENT OF HER
SCHOOL FEES...NOTHING WEY SHE NEED FOR SCHOOL
WEY ETIM NO DEY PROVIDE,EIN EVEN CHANGE HER
HOUSE,MOVE AM GO BETTER PLACE...DEM AGREE SAY
AFTER THREE YEARS WEN SHE FINISH SCHOOL,DEM GO
MARRY...INFACT DI FAMILY OF CHINYERE DON GREE FOR
AM...SHORTLY BEFORE CHINYERE GO GRADUATE FROM
SCHOOL,SHE MEET ONE OF THEIR CUSTOMERS,WEY BE
MULIT-BILLONAIRE BUSINESS MAN,EIN DEY BANK FOR
WERR CHINYERE DEY WORK...AS EIN SEE CHINYERE,E LIKE
AM,ASK AM OUT...AT FIRST CHINYERE NO GREE,TELL AM
SAY SHE DEY ENGAGED,BUT DI GUY WARN AM SAY IF SHE
NO GREE FOR AM,EIN GO COMOT EIN MONEY FROM DIER
BANK...SO SHE CON GREE FOR AM..
DI AMN TELL CHINYERE SAY,EIN DON MARRY,BUT EIN
WIFE NO FIT BORN BOY FOR AM AND EIN WANT BOY...SAY
IF CHINYERE FIT BORN BOY FOR AM,EIN GIVE AM PLENTY
MONEY,CARRY GO AMERICA,DEM GO MARRY,PLENTY FINE
FINE THINGS WEY EIN PROMISE CHINYERE...TO STAT
WIT,EIN GIVE AM 5MILLA,PLUS BRAND NEW MOTOR...
SO WIT DAT KAIN BIG MONEY,CHINYERE CON RESIGN
FROM WORK,BREAK HER RELATIONSHIP WIT ETIM...HER
MAMA TRY WARN AM,BUT SHE NO HEAR WORD...
SHE CON CARRY BELLE FOR DI MAN,WEN TIME REACH TO
BORN DI PIKIN,NA GIRL SHE BORN...DI MAN BEEN DEY WIT
AM FOR HOSPITAL AS SHE WAN BORN,BUT AS DI DOCTOR
CON ANNOUCE TO AM SAY NA GIRL SHE BORN,EIN JUST
WAKA COMOT FROM HOSPITAL LEAVE AM WIT DI
PIKIN...SHE DEY CONFUSE....WETIN CON SWEET NA SAY
ETIM STILL COME TO AM SAY EIN DEY READY ACCEPT AM
WIT DI PIKIN...BUT SHE SAY SHE DEY TOO ASHAMED TO
GO BACK TO AM AFTER WETIN SHE DO AM...HOW UNA SEE
AM?MAKE SHE GO BACK TO ETIM?